[img align=right width=150]https://ichef.bbci.co.uk/news/800/cpsprodpb/143C7/production/_118878828_buhariinlagos-muhammadubuhari'june10ebutemettatrainprojectcommissioning'.jpg[/img] President Muhammadu Buhari enta Lagos on June 10, 2021 to do project commissioning.
Di Ebutte Meta Terminal of Nigerian Railway Corporation Lagos Ibadan rail project na one of di main projects Buhari commission.
Buhari also cut tape for di Energy Nature Light Terminal of di Apapa Port inside Lagos mainland.
Di Integrated National Security and Waterways Protection Infrastructure, also known as di Deep Blue Project follow for di ceremony.
President Buhari last visit to Lagos happun on April 24, 2019, during Govnor Akinwunmi Ambode tenure.
During di June 10 Buhari in Lagos ceremony, govnor Babajide Sanwo-Olu hand over security equipments to di Nigerian president to support police fight insecurity. Nigeria President Muhammadu Buhari don commission di Lagos-Ibadan railway line to begin commercial operations for di kontri.
Di President for di launching of di Railway Station wey dey Ebute Metta describe di achievement as "anoda landmark for di drive of im administration to revitalize di railway system and establish am as a choice of transportation for both passengers and loads."
Di Ebute Metta Station, wey pipo sabi as Mobolaji Johnson Station, na di largest railway station for West Africa with a holding capacity of 6000 passengers. For inside statement wey di Special Adviser to di president on Media, Femi Adeshina sign, e say goment go continue to make rail system priority as transport na backbone wey go change di industrial and economic activity for di kontri.
"President Buhari dey committed to developing a modern national railway network wey go connect every part of Nigeria, and promote trade, travel, tourism, commerce and national integration." E tok. Di statement also point out di benefits of di Lagos-Ibadan corridor plus other railway projects wey dey go on across di kontri.
How di railway projects go benefit Nigerians On how di railway line go take benefit di kontri, President Buhari say railway lines get plenty economy benefits as e go provide jobs for kontri pipo.
''Dis vital line go establish an end-to-end logistic supply chain for railway transport within its short corridor, Lagos - Ibadan, as goods to di hinterland go now dey transported by rail directly from di Apapa port Quayside straight to di Inland Container Depot wey dey for Ibadan from wia dem go distribute am to oda parts of di kontri.
E add join say, one of di challenges of economic growth for di kontri na because no correct infrastructure dey ground.
Di Lagos - Kano railway project wen dem complete am go link di Kano - Maradi line for Kano state.
|